The kind experience wey I get for banking hall today, no be small thing. As I rush climb up to the banking hall, I no believe the kind number wey I see for hall. The one wey vex be sey they get ATM withdrawal line for inside banking hall. OMG! everywhere come tight like sey all of us win lotto. For more than two hours for line, I never move. As I just pose like sey I wan take photograph, na so everywhere dey buy and sell like Ketu market. Wetin? Abi dis bankers too no dey feel the heat or their suit get air-conditioner for pockets. Well, e fit be possible because na only we the customers dey sweat. I tire, on top of that na' im one white and white security man one help person collect for deposit, ah!, na so people dey shout give'm. Noooo! The guy come dey beg, 'na nursing mother o', as e dey talk'm na im one reply give'm, 'mek e go nurse in pikin leave us...we no be nursing mother, we na deposit mother ooo'. Laugh wan kill me. When I know sey this queue thing for the bank na normal thing, na when I go urinate come see line wey long pass the withdrawal line, nobody tell me mek I go back for the queue...
This blog is basically for current and daring issues in Lagos, from politics to everyday hustling life in the city.
Monday, 7 September 2015
'See dat Line na'
The kind experience wey I get for banking hall today, no be small thing. As I rush climb up to the banking hall, I no believe the kind number wey I see for hall. The one wey vex be sey they get ATM withdrawal line for inside banking hall. OMG! everywhere come tight like sey all of us win lotto. For more than two hours for line, I never move. As I just pose like sey I wan take photograph, na so everywhere dey buy and sell like Ketu market. Wetin? Abi dis bankers too no dey feel the heat or their suit get air-conditioner for pockets. Well, e fit be possible because na only we the customers dey sweat. I tire, on top of that na' im one white and white security man one help person collect for deposit, ah!, na so people dey shout give'm. Noooo! The guy come dey beg, 'na nursing mother o', as e dey talk'm na im one reply give'm, 'mek e go nurse in pikin leave us...we no be nursing mother, we na deposit mother ooo'. Laugh wan kill me. When I know sey this queue thing for the bank na normal thing, na when I go urinate come see line wey long pass the withdrawal line, nobody tell me mek I go back for the queue...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment