Monday, 7 September 2015

Early For Morning



Una Good morning, whether you sleep for bed, for floor or you sleep under bridge, at least you sleep at all. Some people no even get gutter to sleep in, because sey the nyamanyama wey dey inside gutter bokwu. Anyway, hope sey you don already dey for road, no be sey you still dey for house na, except sey you no wan commot at all. By now, people wey dey work for bank don sleep finish. Wetin again? Dis kind life for Lagos, na so we go dey go. For other we area for dem south-east and south-south, even north all of dem, na by this time some people dey wake up for sleep. Try'am for Eko, na from that day you go become your own oga, because you go meet your fellow colleagues for break time. Na you go know the kind face you go take enter office. Even sey you be student, na for road you go dey receive lectures. By the time you copy notes for one week, na you go swear for yourself.
So for this morning, just dey do your own thing wella, whether you dey hawk, you dey conduct, you dey control, you dey run after motor...or na for bank, for ministry, for bus...anywhere, just dey do your thing as you dey go.

No comments:

Post a Comment