
As you dey go today na you go know the kind bus you wan enter, whether na Danfo, BRT, Lagbus, Molue or them white and blue or private cabs. In fact the list don long as Uber taxi come enter Lagos. Very soon, dey go commercialise chopper, not to say that people no already dey enter chopper dey come work. Well, na work all of us dey go. The matta na when you wake up, where you dey live, where you dey work go depend whether na BRT, Molue, Danfo, Uber or other nameless ones. But no matter wey you dey work, where you live, Danfo be the Koko for Lagos waka, especially for morning. If na BRT you wan enter for morning, make sure sey you get letter for upgrade, unto sey dat from that day you go become your own Oga. But the one wey pain me be sey all them Danfo bus know sey na dem be the popular demand, but dey no go tidy their bus. Metal scraps everywhere for Danfo, if e no wan tear your cloth, na your body...in fact you go dey careful pass medical doctor. So, mek we all follow beg Ambode to beg dem Danfo drivers to change their moto...for where! Well, time go reach sey Danfo buses go be scraps, so tey e go be like Keke, no windows and doors, na dat time you go know how you wan tek Sidon for inside...but for now, na Danfo all the way.
No comments:
Post a Comment